Wetin plenty people dey ask

The Basics dem

Watin be nano?

Nano na decentralized, sustainable, and secure digital moni wey focus on addressing the inefficies wey dey for existing financial system dem.

Specially designed to take help provide simple peer-to-peer transfer of value, nano dey empower every body with the most efficient and accessible digital moni possible as e dey connect dem to global economy with small impact.

Nano dey provide common-sense experience wey dey feel like digital moni suppose-no bi wahala, no fees, no waiting. Na watin accessible and easy-to-use digital moni suppose feel like.

Na for where I fit get nano?

You fit exchange nano for almost any globally recognized or formally authorized currency/moni dem. Dem get plenty ways to add nano to your wallet. Make una visit the Nano Hub Trading page for the complete list of exchange and swap services dem wey dey your your side.

Na for where I fit get nano for free?

If you go like to test nano out for free, dem get different-different ways dem to take do am. The most popular method na via faucets, wey go allow you to get a small payout after you Don enter your nano address. Dem also get ways to earn nano without sey make you pay. Different different apps and websites wey community members dem dey host go help distribute chukuli payouts of nano when you complete simple tasks, gaming or sey you watch advertisements.

You fit explore all the ways to take earn nano viamake you try Nano page.

Na for where I fit find nano wallets dem?

The ecosystem get wide range of third-party wallets dem, and each one dey provide unique balance between functionality and security.

External developers and third part company dem dey create all the wallet for inside nano ecosystem. Make you no hesitate to get in touch with dem directly if you experience any issues.

Make you browse through the wallet list dem for Nano Hub Wallets page.

How dem take distribute nano? Nano bin get Initial Coin Offering?

Nano dey use novel CAPTCHA faucet system wey dem intend to take distribute nano originally without any magumagu.

Opened for October 1, 2015, the faucet require sey make user dem complete hard CAPTCHA tests make dem fit earn coin dem. Anybody wey get computer fit share time and attention instead of small sustainable mining wey dey associated with other projects dem.

This choice to distribute with faucet na em allow sey make nano fit dey accessible to people wey not fit buy mining hardware or invest for ICO.

This special approach na great way to help spread and distribute nano for the whole world to all the people dem, wey never use am before.

Make you learn more about the Nano Faucet.

Na for where I fit find proof of my transaction for nano ledger?

You fit access your transaction history for plenty websites wey dem dey call block explorers. Block Explorer dey host all the account history of nano ledge. Block Explorer dem na also good place to check nano network's health or analyse the status of your transaction.

Make you check plenty black explorer for Nano Hub.

Na wetin be the units of nano?

1 raw na the smallest possible division, and nano na the standard division wey dem dey use for most wallets and exchanges (1 nano=10^30 raw).

You fit find more details about the units for here here.

The Network

Na wetin be ORV?

The Open Representative Voting (ORV) consensus mechanism dey expand on other designs as e dey providing security with extreme efficiency using delegated, weight-based voting, wey dey allow us achieve consensus with small/chukuli means.

These improvements dem dey provide low costs to handle big transactions and to remove the need to ginger participation with on-chain rewards. No on-chain rewards mean sey no transaction fees and that self mean sey the fully distributed supply, wey dem don complete since 2017, dey ideal for the network design. Instead, na external motivation like to help maintain sharp sharp payment network wey dem fit use without any fee, dey help participants for nano network.

This combination of design decisions wey dey provide easy agreement and dey remove on-chain inventive/ motivation- avoid serious activity and competition power from other network dem. The result na fast and correct nano.

How dem dey take control nano network?

Dem get two ways wey dem fit use control nano network. First, na easy Proof-of-Work value wey dey necessary for every transaction. This go establish small amount of computer resources wey dem need to fit add any transaction for the ledger.

Before any business go dey confirmed, e must get election wey dem start for am and dem must vote for am for the network. Na here dem dey use the second control to reduce how many times persin fit start election for one account. The rule to manage this, dey consider the power of the network, voting activity, balance wey dey for the accounts dem, the status of confirmation of previous blocks for the account and some other details wey dey related to the scheduled elections.

The result na better service for small use and higher balance account when the network usage dey near the capacity.

Why the network no need too much energy?

Dem get three main reasons why nano dey fast and dey energy - efficient unlike other small-small crypto moni dem. The distribution method, the lack of transaction fee, and the ledger's design and consensus mechanism to secure/ take care of transactions.

Because of the one blockchain design of other small-small crypto moni dem, dem must rely on the process wey dem dey call mining to provide security for their chain. Mining na competitive process wey dey incentivise plenty computational resources and energy usage to help win the rewards of transaction fee or supply wey dey new.

This design require slow payment times and dey cause constant feedback circle. This circle dey increase the resource usage wey dem need to win the rewards. After some time, the energy wey dem don waste fit come pass that of the entire countries, and without this resource usage, the system go become insecure.

By providing novel ledger design wey dem dey call the block-lattice, nano dey avoid the bottleneck of one blockchain design. This mean sey dem no need competitive activity dem like mining to build the ledger.

Running Nodes dem

Na who fit run representative node, and na watin be the requirement to fit bi node operator?

To run node na one crucial way to help decentralise the network and provide network access point for systems wey dem built for on top of nano. Anybody fit set up representative and gain voting weight by delegating their nano to the representative. Dem fit also vote on behalf of others wey entrust dem as their representative.

Make you follow the recommended specifications of node for our guide for Running a Node.

How I fit take choose my representative?

To choose representative wey get good uptime, wey also bi unique entity(to fit take prevent Sybil attack dem) dey help maintain high nano network security.

You fit change your representative for every good nano wallet. Make you go for the app or account setting dem and make you look for the representative option. Some wallet dem dey help provide curated list of representative dem to choose from, while nearly all of them dey allow you to directly paste in the address of person wey you trust. If you no fit find this option, make you contact the wallet support team for help.

The koko development

How I fit take stay informed about all technical update and discussion dem?

Dem dey discusses technical update dem regularly for forum, and you fit also consider to subscribe to the technical mailing list.

Na for where I fit access more information about nano roadmap?

The Roadmap project na the primary resource to take see watin dey come for improvement dem for nano. You fit find detail dem of how the board take dey organized and maintained for the related README file.

When e come to track more minor feature and changes dem, the most impactful enhancement dem dey grouped via GitHub Issues where dem dey appropriate.

The nano roadmap repository dey dedicated to dey hqandle some of these roadmap item dem weey go otherwise clutter or fit be unsuitable for the main node repository.

Dem go address discussion dem about their implementation for the community channels like the forum and the Discord #development channel.

Community

Na watin be the different way dem to take dey involve with nano?

Dem get different-different ways dem to take contribute to nano for both technical and non-technical skill set dem. Make you find out more about the Nano Community Program to fit get involved.

You no fit find the answer wey you dey look for?

Make you ask our community member dem.

Make you get some support